SALUTARY IMPACT

SALUTARY IMPACT
SALUTARY IMPACT (HOSPITALITY AND PROPERTY MANAGEMENT)CALL +33605867728

Friday 20 March 2015

Tori! On My Way To Find Daily Bread....................

not real picture

Hmm my people make i gist una wetin my eyes catch ooo... as I enter one area say make I find my daily bread... gbam*** The first person I met at the front desk make sense well well in fact she attended to me like say she sabi me before. She really sabi wetin den tell am.. So my people when I sidon like a cool pastor from vineyard,lol.... if you see wetin I jam pakam. hehe.... na one opeke(clean yellow girl) fresh like apple wey wear small gown that nearly open her hips.. (I cover face).. she was later talking with the lady wey

greeted me very well.. wetin I see next be say she just con sidon near where I dey and open all her garage with fresh tiny green things.>Hmmm** I con dey look am she dey look me and we com they look ourselves oooo. One time e be like say she is restless because the way she dey do... though I don't know where she is coming from  but I take style hear am when she said that they were four in a car with one person.... that's all** lol. Next thing her phone rang oh boy con hear phonetiki... chai..... smiles.... make e no be like say me self too dey form ....she said Hi and me reply "hello" in a real me. lol ..... Honestly, people need to dress properly nowadays oh so that it will not affect the ministry. God bless you all.    More gist later

No comments: